Followers

Sunday, September 16, 2012

I Don Vex

Wetin sef? Who talk say pidgin na yeye language just because e no fit speak am? I don vex. For dis place, na only pidgin I go de talk from now. Wetin sef? Plenty people get wetin dem for likd talk but because dem no fit blow grammar, na im make dem de keep quiet. Make dem die with something wey dem wan talk? Abeg make dem sha talk. Common sense na God de give person.
The other day I de read paper. Dem de talk say somebody na illiterate because e no fit read. Any how anyhow, no matter as person mumu reach, e go fit read picture sha. And by the way, person wey no fit read oyinbo but de fit read Igbo or Yoruba of Efik Boble, se the person still be illiterate?
Ok sha. For the next one month I go de build dis place so dat my paddyman go fit see where e go de enter steady steady. Na all kind thing I go de try bring. Some thing don dey sure na - see list:
FOOTBALL - I go de try de talk true make e for no be say na so so Arsenal I go de talk
NEWS - Dat one na for real
FASHION - dat thing de tire man but I fit de thief am come from other place
EDUCATION - That one sure na because man pikin sef na teacher
YABIS - choi! Na dat one go plenty pass. You for don code na
GENERAL - Anything for enter here as long as no be the one wey MOPOL go take carry Hilux jeep de find only one person.
So people, I go de waka now. Make I go de gather the kind thing wey una go de like.
If you vex, I no send.